Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Trading no be get rich quick scheme
by
Cryptohygenic
on 17/03/2025, 22:12:22 UTC
Di rate way many people especially di younger ones de take rush enter crypto trading based on wetin dem de hear de very alarming. Unto say dem de find online jobs or side hustles, dem go get misleading information say crypto trading na di place to de make plenty money everyday. When dem rush enter and lose all dem funds, na dat time dem eyes go clear say no be get rich quick scheme and say trading no be for everybody.


Wetin u talk via how some people dey see trading as easy source of making money unto say the profits dey come immediately when you catch up good trading strategy na true and that mentality don mislead plenty people for where dem dey pursue quick rich.
But on the contrary Op, trading fit stil make person get quick rich unto say the profits dey come immediately.
So just imagine person way discover winning trading strategies and lucky to make consecutive winnings in a role, I have think em don dey grow to richness be that as e no be like investment way person go chill and no fit manipulate the market on your own to make profits in a quick time rather you go need exercise patient with no other option since personal strategies to make profits no dey for investment like as e dey for trading.