Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Trading no be get rich quick scheme
by
Samlucky O
on 17/03/2025, 23:56:24 UTC
Di rate way many people especially di younger ones de take rush enter crypto trading based on wetin dem de hear de very alarming. Unto say dem de find online jobs or side hustles, dem go get misleading information say crypto trading na di place to de make plenty money everyday. When dem rush enter and lose all dem funds, na dat time dem eyes go clear say no be get rich quick scheme and say trading no be for everybody.
To me I see am say crypto trading na very big gamble wey person no sopos put head if your weight no reach, because if you go do crypto trading while you no get the mind, you fit fall into big sickness if you lose money. I don see many people wey enter bankruptcy due to kind of thing. So I go advice say any body wey no fit do trading make e just invest for Bitcoin den HODL am for long time at least that one go same am from emotion stress and trouble.