Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Trading no be get rich quick scheme
by
Derekfunds
on 18/03/2025, 14:53:11 UTC

Coming to di Op. I don't know what other know about am but me I don see someone who traded in 3 days with thousands of naira and became a millionaire. He traded with N400,000 and make a profit of NN1,840,000. And that happened di time when bitcoin bitcoin been dey rise every hour and I don't know if that one na quick money making or long money making. In my own view people can make quick money from trading if the person e dey good for trading. Though di person go lost money but him go still make am.
Dis na one of di kind of stories wey de mislead many newbies to think say crypto trading na get rich quick scheme. As dem hear say somebody enter trade with 400k and e get profit of over 1m dem go think say na so e easy for every traders, dem no know how much di person don lose for trading, plus maybe na profession trader wey don get plenty experience. Dem no go also know say majority of people wey de into trading de lose due to ignorance of how trading de take work. My advice for newbie traders wey never get experience be say make dem de use small amounts de enter am, so dat if dem lose dem go learn from dem mistakes. Na greed de make inexperienced traders to use huge amounts to trade and dem go most likely lose everything.

By default self newbie no even suppose dey talk about trading because trading no be something person wey no get better knowledge of crypto go venture into. Any newbie wey you see say dey Interested or en wan enter into trading just know say en don see person wey been don make better profit and him too en wan make that kind profit by all means because of big eye and ignorant and funny enough some of them no be even ignorant na something wey them know how e dey actually work but because say there friend dey do am dey make money them too dey wan do am.