Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The future of e-Sim in Nigeria
by
Cryptohygenic
on 20/03/2025, 17:50:03 UTC
This one na medicine after death because our Nigeria government dey always get advanced dreams like this but at the end Dem no dey do am.
How many of us also remembered the introduction of E-Naira? How far of am now? Nothing good still come out of it because the project no get potential.


Since data cost done increase so much like this GLO say dem go give 5GB data bonus to all customers wey go activate e-SIM and with a data plan of at least N1,500 every month.


Leave glo network abeg, the normal SIM way dem don invent na em be the worse network provider we get for the country.
You know how people way dey use the  glo network  dey lost their money on data subscription may dey expire bcos of poor network?
So na 5G data dem want take buy people mind?
Make dem focus on building strong network no be this e-sim be people need.