Bitcointalk I learnt is one of the biggest Bitcoin forums (if not the biggest), but I wonder how many of us already knew about Bitcoin before joining here?
I don sabi bitcoin before I even sabi dis forum self. Na when I Dey school na him I sabi about bitcoin, as a student wey Dey naija university now, money wey dem dey give me for house no Dey do me, so me self wan Dey make money myself, na when I start to Dey look for how to make money, na him I hear about trading that year, but make I no lie, I waste money for trading no be small. All d money wey I Dey get that time, na trading na him Dey chop am, I even put my accommodation money for future trading, I got liquidated, na that time I come get sense, because I no get choice than make I go hustle for roommate.
After I don waste so many money, and I don even give up on trading, na him person carry me come here, I come start to learn things, I Dey correct my mistakes, because since I don come here wey I don sabi how trading Dey work, I no even Dey near future trading again, all my trading no Dey pass spot trading.
I don sabi about bitcoin before I come here, just that the knowledge never too dip that time, I was just trying to learn that time, but as I come forum here, my learning come Dey easy, fasting, and person come Dey make money again for here.