Di rate way many people especially di younger ones de take rush enter crypto trading based on wetin dem de hear de very alarming. Unto say dem de find online jobs or side hustles, dem go get misleading information say crypto trading na di place to de make plenty money everyday. When dem rush enter and lose all dem funds, na dat time dem eyes go clear say no be get rich quick scheme and say trading no be for everybody.
I no go talk say trading no be for everybody, e dey actually for everybody wey know say him fit pass through the ups and down of it until them become profitable trader. Wetin most people no understand for trading na him be say, no be get rich quick scheme and if you wan begin dey trade as a funded trader, make sure say you dey gallant to some extent and make you get means of income wey you dey rely on for your daily means and no be wetin you dey expect to get from trading you go rely on. Many people give up because they don blow account finish and dem no get another means to fund their account again, that dey very discouraging and go make many people lose internet for trading sharply. Make newbies learn and know wetin them wan venture into before them meet with regrets.