Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Understanding is the best key to approach cryptocurrency.
by
CryptopreneurBrainboss
on 20/03/2025, 23:46:17 UTC
without the proper understanding and the awareness that cryptocurrencies are designed to fluctuate rapidly and unpredictablely in price you we refer to cryptocurrency as a scam.

This na why them say make you no invest into something wey you never understand yet because how person wey they call himself an investor inside Bitcoin no go know say the price of Bitcoin no dey stay one place. Before you invest inside something, make sure you do small research to know wetin that thing they really do so you no go put your money for something wey no go give you peace of mind.

Know wetin Bitcoin be, how to store am well and how to send and receive Bitcoin without your wallets getting compromised or losing your assets from our carelessness. Information is powerful and anybody wey no dey inform, no go sabi how to make am for life. As you sabi wetin you dey do and they do am well, you're already closer to being successful whether na for crypto oh or for anything else for life.