What's your take?
My take be sey na confused people dey rule us. We nor even fit stand on awa policy, na to dey copy copy from America. I already know sey na so e go finally be as soon as Trump enta office and begin show more support for cryptos. Awa govment nor get choice other than dat na. If America govment coughs, awa govment go also wan cough even if na piss dem be wan piss before. Money wey dem for take style make from Binance by making dem take a certain commission off trades wey we do like Kucoin been dey do then. But as soon as dem see sey America govment fined Binance and got something from dem, na so awa own chook head put. Shey e nor backfire for us? Of course it did.
Now, we wan begin play catch up on cryptocurrency matta wit others wey don even leave us behind.