Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 8 from 5 users
Topic OP
Shine your eyes make person no scam you using email wey look like exchange own.
by
Joy- maker
on 26/03/2025, 08:32:54 UTC
⭐ Merited by NurseHub (3) ,Marvelockg (2) ,Mia Chloe (1) ,AmaGold70 (1) ,Churchillvv (1)
I just say make i read news this morning, along the line I come see one news wey say phishing scam please be careful for reddit.con and I come open an come see as person dey share ehh experience say ehh receive email claiming to be CoinBase from info@info.coinbase.com and the Email title now [Action required] Confirm your info by 2025-02-20 source:
https://www.reddit.com/r/CoinBase/comments/1is20o3/phishing_scam_please_be_careful/
see as ehh dey real like email coming from CoinBase, and  they wey the email address dey ehh go make you believe say now from CoinBase, because the email end with CoinBase.com why now fake email from scammers. See CoinBase email address support@coinbase.com.
My advice now try dey confirm any email wey you receive from any exchange or from anything at all before you take action, because scammers get many way to use scam people online.

I can remember back then when I encounter something of this kind which I fell victim, but my own no for crypto now for one platform wey i be dey do small small investment, one day I come receive email wey say make I click to confirm the action say my investment go double in next two hours so as I click an I come wait for 3 hours when I come go back to the platform I no fit access an again till today my money don go no trays.