I understand watin you dey talk but no be only for bitcoin this things dey happen.
Infact anything way involved money people dey dey careful.
Most people don fall Vitim before, so e hard to believe.
And secondly you no go expect person way no Sabi book to come dey reason bitcoin na....I mean person way no dey expose. Some people believe on eye way see, them want where them go put money today collect am tomorrow or say assurance follow the money to come back. So even as them dey see the others dey gain for bitcoin, them dey feel say one day their money go go. No be as u take tell them, na as them their self take understand am to put money. Money matter na life decision no be the way u talk am.
I be perfect example, when I been wan know watin my guys dey do, I ask them....when I wan do, him ask me if I fit leave my money for long, my reply funny. Me way never get money Mk I leave one for somewhere? Abeg I no fit oh....so u can see. No be everybody go invent on bitcoin.