Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: Religious leaders no suppose venture into politics.
by
Pressurizedem
on 27/03/2025, 03:08:36 UTC
Na true say the people wey dey call themselves clergy men no supposed put hand for politics or contest for any political position,but because everything today is done for Money,e don make almost every aspect of human life corrupt, including religion.Pastors wey we get now no dey reason the consequences involved again,as long as the matter go put food for their table,dem no really send,and in some cases sef,I no even dey blame them much because the country dey bad,nothing dey really come out from any angle,so if politics wan dey of help to clergy men,then I don't have a problem again.