Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: School drop out, unwanted pregnancy and divorced - my personal view on these!
by
Pressurizedem
on 27/03/2025, 03:19:47 UTC
Make I no lie, the judgement wey people dey place on these individuals wey Op mention dey mostly come from we African sides, and I stand to be corrected but nah wetin I don see. Society don make am look like say if you be school dropout or a divorcee or a single parent, e mean say you dey incapable of doing anything again and as such people supposed to see you like liability.
I no see anything wrong in being a single parent. The question you need to ask is; can that person take care of the child or not? I dey hear this term "unwanted pregnancy" and sometimes I dey ask myself why e dey unwanted in the first place. The deed has been done and whoever dey responsible suppose to act as one but e dey look like say with how society dey regard girls wey carry belle at a young age as incapable nah dey cause these issues of abortion and all that.
 E no get as e wan be, people must talk about you but wetin go make the difference nah how the individual wey fall under the category wey op mention react to those things. Big names wey we know today like Bill Gates, Steve Jobs, Zuckerberg and even Micheal Dell all drop out from school but look where them dey now.
You dey correct mate,but wetin I see here na their mentality.Wetin dem dey think of themselves when them don drop out already? Some of them dey feel say nothing good go ever come out of them again,while some of them dey reason say na the end of life be that.When you drop out of school and you be single mother,first,you don place yourself in a position wey be say e go really push you to either hustle more of give up on life,but if you have that mentality of never giving up,and determining to change your situations,then you can change that narrative for yourself.