Should the corpers endorse Tinubu for second tenure?
Sae wetin happen? because of sae em do wetin em suppose do as a president, corpers go now think of endorsing him for second tenure, knowing the kind hardship wey dey for d country, and after their service year no available job kept for them to be managing till that stand fit to cater for themselves.
It will be irrational for any Nigeria to come out openly sae em endorse Tinubu for wetin em d cause for our country. The level of hardship and the cost of living wey d for country, Nigerians never experience am before since the creation of this our country called Nigeria. Wetin go now give you the reason to endorse person wey don bring poverty, insecurity, abuse of power, come our side, sae make we vote for am for second tenure. Sufferings no d tire that person?!!! I wonder.
I just dey talk because we sabi forget in this country, by the time wey election go start dem go gather kopas make dem support Tinubu for president and you go see some people wey go openly support the move. na naija we dey, we like to suffer and smile. kopas sef fit say Tinubu don try for dem by increasing the allowances but make dem know say, the 19k we ear them is more valuable than the 77k today. As kopa i fit use 10k stock my kitchen then, but u can't stock kitchen with 77k today market, the Tinubu lead administration don take Nigeria 3 steps backwards in all ramifications.
so such a person do not deserve second tenure, and i support you mate, no reasonable Nigerians should vote Tinubu come 2027, make we show say him don too suffer us, and we no need am again.The 77k no reach for kopas to endorse him for second tenure.