Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: How do I improve or upgrade myself in this forum .
by
SmartCharpa
on 31/03/2025, 13:21:48 UTC

Criticism no dey encouraging learning oh especially for beginners


That na for person wey no wan grow. Because  for this life no matter watin you do people go Criticize you, and even inside advice wey person dey do e dey Criticize something wey you no dey do right, more especially for this forum wey other regions and continental people sef dey. I remember wen I be newbie for this forum I made some post for public board and the response wey I get make me be wan give up to some level, but na later I come realize say no be to dey talk or make post, na to learn at that stage. That one come make me serious with my research, na once I ask for materials to build my knowledge and it helped me. So you fit see Critism as a big discouragement or as a hint to somewhere wey you no dey do well, and na to work on am go com be the next tin for ground.

This one na better thing you yan so, unless the person never dey ready to learn, otherwise, people go criticise you for whatever you do for this life. They can attack you for where kobo no dey comot, talk more of this forum wey don helped people a lot to learn and na for this forum majority of us take dey guide. Op dey ready to learn for this forum, despite that freedom of speech dey but who don pass you don pass you be that, even if him sabi pass who dey correct am, make him play along because is part of learning.

Many newbie’s don come this forum and go, no be everybody get the mind to see their fellow man dey talk to them anyhow and if you wan to become successful in this life you must have patience, if we think say we go mind the way dem dey follow people talk before for other boards, many of us no go reach here and the story of our lives go dey different.