I no say na bitcoin and anytin that is related to cryptocurrencies we dey discuss in dis local board which is d reason I bring dis topic for we to chuck mouth as bitcoin and cryptocurrencies users, bitcoin is d king of all cryptocurrencies which is true in my own observation because bitcoin has d highest population of investors and traders in d crypto space, bitcoin is d first cryptocurrency to reach $100k in d history of cryptocurrency, despite d predict some people predicted that bitcoin will not get to dis amount before it will decrease for other cryptocurrencies to take d lead, is there any cryptocurrencies that share d same price with bitcoin now? d answer is no, to show say bitcoin is d king of all cryptocurrencies. Wat is your opinion forum users.
Bitcoin na him be the first cryptocurrency and any other coin wey you go think of today wey dey exist na behind bitcoin them be and them no fit overtake am now, or even in the future. The consensus wey them build this bitcoin on top dey very different from all other coins and na him make him things dey different so. And any other coin wey try to imitate am, them no get fit reach and them go all fail. With wetin Bitcoin don achieve, them no get any coin wey don come close to achieving half of that, so he make sense for us to put more focus on Bitcoin than any other coin no matter how persuasive them come with their own things.
Are you bringing this up to know who's actually supporting Bitcoin or not,well don't expect everybody to see Bitcoin as the King of all coins…
….. With the promising future of Bitcoin,I believe Bitcoin will one day become the king of all valuable assets in the world.
No be everybody go see bitcoin as the king of all coins but make you know say anybody wey don already believe in this technology and also have this enthusiast mindset, then bitcoin na him go be their king of all coin. Even when them dey trade or hold other coins, na still bitcoin go be their main priority.
Top valuable assets for world today plenty but if you dey mention the top ones and you never call bitcoin, then you never really talk true for the matter. Bitcoin don already win that one and na wetin no fit dey disputed again. E dey on its way to top them but na gradual process until e come turn reality.