Yesterday I received a call from someone telling me that I am qualify to receive 75,000 from APC.. that is a fund we should put in our business for growth and whatsoever. I was just having patient to see how where he gonna land on his talk, I sent my account number to them and after few minutes I received an automated code starting with my FCMB as message from the bank without them knowing I knew where they were driving to, I just have to endure to see what they would do. When sent me automated messages to copy code and sent to them, on the process they would call I will pick and they said I should call otp send to me that I shouldn't share with anyone and I said ok, but guess what?
We suppose don know say nothing like free money for this country again, anything wey look like free money, make we Dey suspect am, e fit be scam. The current government wey be say na their pocket dem care about, na the same government go come they share free money, instead make them share the money give masses, them go hide am join the ones wey they don still before, so anything for this country, me I Dey see am like say na scam.
If the government come even decide say they wan give out money, make we assume say our country don change, and true true they wan give money, nobody go even call Dey ask the back wey you Dey use, or go they ask make you send them OTP code, na automatically na him government go credit account, you go just come see credit alert, and nobody go even call you. Anything wey make you don Dey receive OTP code, and person don Dey call you make you send the Code give am, then na 100% scam, government no go do like that.
E really make sense as you carry the matter come here, no Dey surprise say something like this never even happen to some people before, and they never hear about am before, but as you carry am come here now, everybody go learn.