Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Understanding is the best key to approach cryptocurrency.
by
Jerrycrypto2024
on 05/04/2025, 06:36:06 UTC
OP, you need to understand say majority of cryptocurrency na scam make the dev them create the project to scam people through punp and dump. This na e make me feel say new people wey dey come the cryptospace no need know any other coin apart from bitcoin. Bitcoin na e be the only legit coin wey people trust and believe. Another problem be say those wey come know about bitcoin won use am make money fast through trading even if them know say na through long-term investment them go fit use profit and limit the risk.

Wetin you talk na true because most of the people wey no no anything about bitcoin, when they hear cryptocurrency dem dey feel say na all be bitcoin without knowing say bitcoin na separate coin on yin own. One thing wey i discover say na the problem with people wey dey invest for cryptocurrency be say dem dey invest wit the mentality say as soon as dem invest na for the price to start rising so that dem fit take profits but wen dem see say e no work like that again dem begin call cryptocurrency scam. If dem go fit know the difference between cryptocurrency and bitcoin dem for understand say na bitcoin be the only reliable coin wey dem fit invest and stand an opportunity to make profit in the long term. Anybody wey get the idea say dem go fit trade bitcoin come make profit within a short period of time na deceive the person dey deceive himself or person wey introduce dem no tell dem the truth of how bitcoin investment dey take work.

The truth remains that ignorant is a key but there is an aspect those who believe or call crypto scam centered their heart which failed them and they generally tag crypto scam , which is not far from get rich quick some see investing on altcoin or shitcoin as something that happened as speed of light once they invest within a tinkle of an eye the investment will skyrocket but when the reverse become the case where the dropped goes beyond their expectations you see them lament of scam, this is Also as a result of ignorant as op highlighted a good investor with knowledge will override this thought of quick to get rich in crypto and know the best to go for not shitcoin or meme coin without future even if he is given a trial not to the length that the loss will affect him to be lamenting scam or condemned anything called crypto.