Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: DCA strategy used accordingly
by
MarryWithBTC
on 07/04/2025, 10:25:12 UTC
One thing wey dey make DCA method and investing as whole easy na for investors to have one thing in mind , before you dey plan to invest bitcoin make you just dey sure say you dey invest for longterm because if you no dey sure about longterm to accumulate bitcoin dey always dey difficult. You fit buy today but because of the dip of the market you fit end up sell. Investing bitcoin requires understanding,  planing and to make good decisions and stand by your decision,  these the only way it will be possible for one to be able to accumulate bitcoin for the future.
I no sure say the DCA method get anything to do with investing for long term, what will help the investor to hold for long time is to plan the money well so that him no go use feeding money put into Bitcoin. If the money wey him put na money wey him fit leave for five years inside Bitcoin, then nothing go stop him from holding. People wey dey fear to HODL na people wey dey think say them go make big profit over night wey make them carry all their money put inside Bitcoin only to find out say no be so e be. The DCA method dey help sha because e go make you invest small small over a long period of time.
Na true wey you talk. People wey go carrry money dem wan used do project, or pay house rent or pay school fees go put for bitcoin, dem go always panic when the market dip. So if people invest wetin dem fit lose or money wey dem no dey in dare need of, dem no go too panic when the market red.