Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: How do I improve or upgrade myself in this forum .
by
Obari
on 10/04/2025, 15:21:39 UTC
I’m glad you’re already conscious of the fact that you might criticized at some point even when you think you’ve given your best but hey, don’t ever get discouraged but let them be your motivation.

That's how criticism should work for you, don't take people negativity or correction as a reason to give up. If you never fit dey see the good side of what people say about you and take out the bad ones to work on, you never ready to become somebody whether na for the forum or for outside the forum. Just dey improve on your self in every way possible and know say if success been easy, e no for sweet.

The struggle and everything na wetin make when you finally make am, e dey sweet for body. The forum no hard, just find your way around as there are different ways to get merits. People done use translation of post take rank up, others done use the posting of valuable topics while others replies only so way dey everywhere na just say make you look for the one way go work for you and concentrate on that.

Your first paragraph too sweet me and the second one just burst my head because you truly be one major asset wey our local board get.
Truly if success easy, e for no sweet Ajeh and na why when we finally succeed for something, the joy that comes with the success is always immeasurable and this thing wey you talk like this suppose Dey framed for my parlour make everybody Dey see am say, truly success no easy and a lot of people Dey even think say, life na bed of roses for person wey fit Dey get am clear forgetting day, there have been prices paid.

Criticism na one thing wey we need to even grow but na how you take the criticism actually matters because as a child, I Dey remember one story my mama Dey always tell about how person use basin insult her because she been go to borrow and she was feeling bad with tears in her eyes, another woman also walked up to her Dey remind her say, these things na the major reason she suppose buy her own and ever since then, she took the challenge and the rest is history.

Just learn to take corrections and try to grab the positive from every criticism thrown at you.
Peace.