Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: African Proverbs in Pidgin
by
Obim34
on 11/04/2025, 18:12:13 UTC
Make i drop one funny proverb.

Instead of food to waste, make belle burst.

Meaning: Don't be wasteful because money is use to pay for everything.
D interpretation nor be am oh. For belle to burst mean sey d persin go force himself to eat dat food. E bi like when persin tell you sey instead wey I go leave dat thing for you, make we die here. D way wey me take understand am, e mean sey make persin nor overdo things.
I don come across this your reply for days now, but i just they try see if i go fit read another better meaning, i catch the flow for wetin u talk so, i take the meaning too centered on Food > Resource > Money, which no fit into the exact meaning.

Well done @Mpamaegbu, sometimes when you begin give responses i dey feel like say you done dey operate on walking stick, like them with grey hairs. I go edit older post for clarity as others fit come across am.