I see this news on Friday about CBEX when people come the talk say the platform done crash and people done lose all their money them invest inside. For those way no know waythin be CBEX, it stands for China Beijing Equity Exchange. According to them say nah digital asset trading platform way you fit dey trade. But plenty experts done the warn say the platform gets all the look-alike of a Ponzi scheme just as MMM was. Now since Friday 11th April Investor never fit withdraw their money and the platform the drop message say nah till 15th April them fit the do withdrawal. Somebody now the cry say him no fit withdraw him $60,000 him put inside and many others too.
Me I never hear about the platform before, if no be say you dey talk am now, me I no even sabi say another Ponzi scheme Dey wey people Dey run now. Most of the people wey Dey fall for all this Ponzi scheme, na people wey Dey hustle for free money, or make I talk say people wey Dey look for quick money. If I Dey see any platform wey Dey talk say risk no Dey Wetin I Dey invest in, and I no fit lose money, then I Dey commot hand, e don show say the Platform is owned by scammers, because for every investment, make we know say risk Dey there, and chances of losing money Dey.
The reason why most people no Dey like invest in bitcoin, and them Dey prefer to put money for all dis Ponzi scheme na because some of them no really know much about bitcoin yet, and dem Dey believe say d Ponzi scheme wey Dey put money no go scam them, and some go talk say before Dey go run, Dey for don make there money.
Some people na just quick money dem Dey look for, and dem believe say na from all this Ponzi c
Scheme Dey go fit achieve that, na why people like to Dey risk their money for even all this meme coins, na coins wey fit give mad profit within a short period of time.