Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Guide on how to invest in bitcoin and altcoins
by
MainIbem
on 13/04/2025, 09:30:51 UTC
Try start with one first after you finish the other you fit start the second one. I go advice you to settle down with bitcoin you no really need to invest for any shitcoins for now because those coins Sabi drain person portfolio. You know say that one dem dey manipulate am well. But hard to see say dem manipulate bitcoin. Bitcoin na the only digital currency without manipulation. After you get enough bitcoin for account you go try invest small for altcoin but they careful.

Na true you dey talk every Cryptocurrency enthusiast first priority supposed be Bitcoin, especially new ones wey just dey come into the market, their first priority suppose be to gather enough Bitcoin overtime for their Portfolio then when they done gather plenty they fit choose to put body for other coins that one na their choice no be financial advise from me na their personal decision, other coins na mostly pump and dumps and their owners they easily manipulate am so instead of to risk money for something wey person go end up come dey regret eh better make dem choose better coin wey be Bitcoin invest inside, the only requirement eh go need na just to dey patient then use better wallet hold  am for years