I see this news on Friday about CBEX when people come the talk say the platform done crash and people done lose all their money them invest inside. For those way no know waythin be CBEX, it stands for China Beijing Equity Exchange. According to them say nah digital asset trading platform way you fit dey trade. But plenty experts done the warn say the platform gets all the look-alike of a Ponzi scheme just as MMM was. Now since Friday 11th April Investor never fit withdraw their money and the platform the drop message say nah till 15th April them fit the do withdrawal. Somebody now the cry say him no fit withdraw him $60,000 him put inside and many others too.
If we get anybodi here wey be victim of dat CBEX nonsense, we supposed pour am water wey pepper dey b4 we wipe am 2 by 2. I nor get single sympathy for anybodi wey fall for Ponzi bc most of dem dey get idea wetin dem dey do and go still chook head put. These people want fast money. Dem dey neglect the process of sowing and harvest seasons..
Hahaha abro you funny oh, person when done lose money ontop na you want wipe am plank that one no be double whahala.
I do grap what you mean because na the height of stupidity say person way they this our forum and know about bitcoin go come still the go backyard the do Ponzi scheme instead of to invest that money for bitcoin. Me when just come the forum I know how much things I done learn sef not to talk of people when they here before me. For this life anything way be fast means of making money no the end well, either e go take your life short or you go lose something valuable.