Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: E get any risk if person dey always trade with one P2P merchant for inside excha
by
Mpamaegbu
on 17/04/2025, 10:15:14 UTC
⭐ Merited by sokani (1)
Wetin fit be the possible dangers of doing P2P transactions with only one merchant for these centralized exchanges wey still dey function like ByBit, Remitano and the others?
Since wen I read a guy's post and wetin him passed through in d hands of EFCC, I dey like deal wit different merchants. Dey invited him and during d cause of questioning him dem com reason wan particular account wey him dey often receive funds from. Dat account na from a certain merchant wey him dey like deal wit for exchange. D guy had to open up to dem as e take be, and you know how those mad people dey take behave once dem sabi sey cryptos dey involved for matta. I nor wan dat type of scenario. So, wetin I dey do na get a range of up to 10 different merchants wey dey good. I make sure e tey b4 I go repeat a particular wan.

We just dey pray make we no do trade with the wrong people wey go fit bring problem for us later.
My dear, na d prayer be dat everytime wey we do exchange. Na d reason wey make me nor dey like trade with any merchant wey nor warn against the use of thirty party account. I dey like deal wit those wey dey pay from their own personal account. I nor need corporate and business names na there persin fit get gbenge sef. You neva can tell d persin wey dey d other end, whether na kidnapper funds dem dey try launder through cryptos.