But shall, our ogbonge EFCC don assure us say their hand already they on desk to track and recover our money but make we give them time say around march them be don warn us say make we Dy alert for all there Ponzi schemes. Currently now them don Dy communicate with Interpol concerning the issue. So make we relax our money no fit go like that.
This one wey EFCC enter this Mata, hmm, the lost too much. Abeg effcc do something. Even if na for everybody to contribute some percentage give them after the successful work e for still good too.
Oga nothing Efcc go fit do for this matter bcos dem too get their flaws and dem too like bribe. U go only feel this excited as now but as time goes u no go hear from Dem again after Dem don involve for closed door meeting and get their own percentage if actually dem fit trap this scammers.
Wetin the Efcc don do for we govt people way dey pack our public monies? Leave am oh. Those people no dey genuine get hope on deme.