So many other Ponzi scheme don come and go but this one pretend to be genuine thereby deceiving and gathering members.
Of course, Ponzi schemes go always pretend like dem go betta people lives and na im make gullible people dey fall for dem. I used "gullible" bc anybodi wey fall for Ponzi nor dey wise, especially those of use wey don already dey exposed to how investments generally dey take work.
But shall, our ogbonge EFCC don assure us say their hand already they on desk to track and recover our money...
EFCC, ogbonge? Dat wan funny me somehow sha bc you and I sabi sey EFCC na barking toothless bulldog dem be. Nothing go come out of dis wan. Otilo! Even for MMM, how many people dem catch? Shebi d Ugorji guy wey dey head of d MMM thing dey abroad dey flex himself till today. Abeg, make EFCC park well.