Our govt no dey try at all,why Dem no shut Dem down when they were still operating becos I hear say Dem even get physical offices. Abi EFCC go talk say Dem no dey aware of CBEX operations in Nigeria. My opinion for this matter be say, victims of CBEX scam should move on with life bcos dia money don go. EFCC no get anything to do for this matter. I believe the reasons why EFCC even involved themselves for this matter na bcos of make e no look as if them no dey active as na there work to stop financial crimes for the country. This one go teach people not to trust any platforms wey dey promise huge returns in a short time.