~snipped~
Make we no use because say them pay begin they see them as legitimate because say every scam once started as legitimate.
Na true you yarn there sey every scam dey everly start as something wey dey legitimate. Shebi na so this latest CBex scam take start too. Anyway, make I nor even carry talk enta dat wan now. Back to Pi. I follow chop small there but nothing much. I nor start early like many bc I reason am sey e defile most things wey I sabi for dis industry, especially as e dey ask for personal data. Na until I begin see where dem dey trade am I begin put interest late 2023. So, I nor start on time. D listing price in Feb nor be wetin people really expected but e still good if we check d huge supply we e get. Maybe d devs go need burn some tokens so price go fit go up well.