Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Goodnews to cbex investors.
by
Stable090
on 18/04/2025, 21:02:29 UTC
My country people all these Ponzi scheme don too do us something, make we shine our eye o. This current cbex Mata shake the county and the second in the country after MMM. So many other Ponzi scheme don come and go but this one pretend to be genuine thereby deceiving and gathering members. All other Ponzi schemes wey don come before MMM and after MMM no reach this one. this one na second in rank to MMM. Them collect up to 1.3trillion from Nigeria for this kind hard economy.
Wetin Dey pain me with dis our country people be say, we no Dey learn from our mistakes, we don see different Ponzi schemes in the past wey scam people, and new ones Dey come but we no Dey learn from Wetin don happen before, people still Dey put money.

E Dey painful say out country people never still learn, one person talk say make I come do that CBEX that time, but the only thing wey I tell am be say I no get money, me I know say na Ponzi scheme, and Dey don brainwash the guy already, so anything wey I tell am, him no go listen and I no get energy to Dey explain self, so I just tell am say I no get money.

As dis CBEX Ponzi scheme don happen, and people lose plenty money for am, no Dey surprise say if another one come up again, people go still join am now, I don’t know the kin crazy risk wey people Dey take. And about our EFCC matter, me I no Dey believe all those people, me I no really think say people go get their money back, na investigation na him EFCC go Dey do until the matter go die down.