Be it linked to the hack or not, or maybe the coin that eXch processed for the hackers is not up to the investigated amount, we just know that Lazarus group is responsible for what that happened.
Well, e no come to me as a surprise becus of their rule in di Bybit hack. Normally, as di hack bin happen, everybodi for space bin stand with Bybit, give dem every support wey dem need. Di platforms wey Lazarus group take launder di stolen funds bin freeze and return di money back to Bybit. Di exchange choose not to do so, becus of di beef wey dem bin get with Bybit. Dem say dem go donate di stolen funds to open source projects. Weda dem do so or not, I no kno. For me, e no make sense becus di money no be their own and I no say their action go get consequences.
Normally we supposed to be brothers keeper for this industry in a situation like this but we can't really blame any of the party based on say both of them dey try to protect their business. Although, no be the best time be that for eXch to revenge wetin Bybit bin do them that time and nothing fit justify their action despite na Bybit first do them. That kind incident fit collapse person business if Bybit no really dey strong and have back up. eXch too no wan go against their policy but I think if things continue like this, fraud and money laundering go dey increase henceforth.
Wetin I no really understand about all this saga be say, this Lazarus group na indomitable group wey nobody fit handle or arrest them? Dem no fit use any tool to track them and give them wetin dem deserve? They're well-known group wey dey carry out this kind illegal operation and still going around freely without being caught. Abeg make person clear my doubt why dem no fit touch them.