Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Common investing mistakes wey people dey make for this crypto space.
by
Mekie21
on 21/04/2025, 21:36:10 UTC
You really highlight most of the mistake most of the newbies wey dey come into crypto space dey experience, not just newbies sha.  As long as one of their friend don tell them say them make am from this or that coin, them just dey go straigh go dump money for the coin and when e come go against their expectations, Dem go end up regretting…. When I first start this crypto stuff I been think say na quick money avenue buh with time I come Dey learn gradually. I come get to understand say for the crypto space say you dey pay for your mistake with Dollar. Now I Dey sacrifice my time to learn about any investment wey I think say get potential and I fit invest my money on… This your highlight make sense.