Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: E get any risk if person dey always trade with one P2P merchant for inside excha
by
SmartCharpa
on 23/04/2025, 12:36:50 UTC
Wetin fit be the possible dangers of doing P2P transactions with only one merchant for these centralized exchanges wey still dey function like ByBit, Remitano and the others? I dey curious because aside say one or two small price difference in kobo, e get any danger? Now, nor be say the transactions dey happen out side of the platform, e fit be say once you don trade with the merchant before and you come like them based on their price and how fast dem dey pay, you decide say anytime you want trade you go contact them to trade but everything go still happen inside the exchange just to dey safe.

I don heard about this exchange call Remitano before but I never make use of the exchange before, but I am sure say na better exchange because nobody has ever complain about the exchange before. However, i never imagined it say I should always be doing p2p with only one merchant because sometimes I might be in a position that I need the money urgently and that your favorite buyer no go dey active, your only choice is to do the p2p with another buyer.

In addition, I see vendors who can trade outside exchange, but we must dey very careful. even though everything will still happen inside the exchange, i no sure i go choose one person as my favorite vendor only because of small small change wey dey difference. E just be like greediness and make greed no allow us to become a victim to any of these scammers.