Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: E get any risk if person dey always trade with one P2P merchant for inside excha
by
Rgram
on 23/04/2025, 13:24:44 UTC
Wetin fit be the possible dangers of doing P2P transactions with only one merchant for these centralized exchanges wey still dey function like ByBit, Remitano and the others? I dey curious because aside say one or two small price difference in kobo, e get any danger? Now, nor be say the transactions dey happen out side of the platform, e fit be say once you don trade with the merchant before and you come like them based on their price and how fast dem dey pay, you decide say anytime you want trade you go contact them to trade but everything go still happen inside the exchange just to dey safe.
For me, E sha no too get risk i but in most cases wey you don trade with vendor for like three or more times come build trust sef..at some point you go start to send am coin direct to wallet not even on P2P and in most cases the vendor might runaway with your coin depending on the amount of coin and his integrity..