Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: E get any risk if person dey always trade with one P2P merchant for inside excha
by
Mpamaegbu
on 25/04/2025, 01:25:20 UTC
Anoda one be say the trader go get your phone number.
You see dis wan so, na where most of awa fintech banks nor get am right, especially Opay and Palmpay. I nor know wetin make dem choose to use phone numbas as awa account numbas. E nor too make sense. I like as Moniepoint and Kuda take dey run dem own.

Quote
If nah bad person, him fit track your location, come rob you if him suspect say you dey fucking rich because you dey trade huge amount in crypto steadily with am.
Na for dis purpose make me nor dey like put on my location, unless e get something wey demand am. And once I'm done wit dat thing, I dey put am off sharp sharp. Make wetin persin nor know nor com chop persin head.

Quote
So to be on a safe side, using different merchants every now and then dey better.
Make I add join dis wan. I nor dey like trade more than N200k wit any merchant. I dey share am. For such volume, I dey like use different vendors and e get why. Na so make d volume nor too much to begin raise eyebrows.