Wetin fit be the possible dangers of doing P2P transactions with only one merchant for these centralized exchanges wey still dey function like ByBit, Remitano and the others? I dey curious because aside say one or two small price difference in kobo, e get any danger? Now, nor be say the transactions dey happen out side of the platform, e fit be say once you don trade with the merchant before and you come like them based on their price and how fast dem dey pay, you decide say anytime you want trade you go contact them to trade but everything go still happen inside the exchange just to dey safe.
I no think say anything dey wrong, but the matter just be say I dey prefer to deal with different people provided say Dem dey online, I no dey like make I do do deal with one person make e no come master me to the extent say even when the person don dey do me strong thing I no fit talk. The truth be I dey avoid over familiarity. It's either you dey online we deal or you no dey online I do with another person. You know when you don dey used to one person, e go dey cause you inconvenience sometimes in the sense that you fit wan sell usdt but base on say your customer never dey online, you fit just decide to wait dey inconvenience yourself for the sake of good price. At a point you go believe say na him they offer best price for the market even when him don dey cheat you, you mo fit leave am for the sake of relationship. So for all this reasons I dey totally avoid am.