Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user

Re: Info-thread: Translation of Useful English topics to Pidgin {mix images}
by
Abdulzuruku01
on 01/05/2025, 15:40:56 UTC
⭐ Merited by Pmalek (2)

Translated Topic in Pidgin Language; I lost my Nostr keys (and how I take recover dem)
Original Topic: Blockstream Jade Review
Author: Pmalek



My plan na to make post wey go focus just fo one feature and issue wey I get wit my Jade, but den I con tink say why I no go write small review about dis hardware wallet. So, here e dey…


I buy di Blockstream Jade few month ago from di official shop fo US and dey deliver am come EU. No be most affordable way bcos of dere are shipping fees, import taxes, and customs fees (e depend fo di destination of di country but I no worry about dat bcos I be wan buy am from di manufacturer directly and no be from reseller. U fit save some money buy am from di reseller fo yur country, especially if na di shop wey dey close to u wey u fit visit and not to leave ur personal details somewhere fo di server.

na Bitcoin I use to pay for am. Di Blockstream store dey accept crypto via BTCPayServer, which dey nice.

Box Contents

Na di box content be dis:

•   Jade hardware wallet
•   1 USB cable
•   1 Recovery sheet
•   1 compact SeedQR templete fo 12-word seeds
•   1 compact SeedQR templete fo 24-word seeds
•   A Get Started manual




Blockstream fit do better here. You go only get one recovery sheet. Dey could suppose add at least two. Di same tin for di SeedQR templetes.

Di Setup

Befor i set my device up, I first download di latest firmware. Blockstream dey gv u few option here: You fit install di firmware from di Blockstream Green software wallet, di web portal, or di advance setup wey require copy of di repository and use di command line.

I upgrade firmware thru di web portal. You fit choose one of two firmware versions. One get Bluetooth enable, and di other one come wit di disabled Bluetooth capability. I go wit di second option.

Blockstream Jade get di Basic and Advance setup. Di basic option dey requires di device to hold ur seed, like di standard hardware wallet. U go also generate PIN code wey u go use wit di blind oracle wey dey function as di virtual secure element.

But my target na to use Jade as di stateless signer, which require di advance setup.

Na where di SeedQR template con takeover. First, u go need generate di 12 or 24-word seed and back am up well well. I also add long passphrase for extra security.

Den, na time to create ur SeedQR. For dat, you go need di sharpie or di marker. u use am to place small dots fo di provide template sheet. Dis process dey take some time, and I dey very careful wit am since Blockstream only give u one copy per 12/24-word seeds.

When I don finish, I double-check everytin and make sure say  I go fit recover my wallet.

Export di Master Public Key

Because Jade na airgapped hardware wallet, e needs  internet-connecte companion software app to create
di broadcast transactions. Dey gt plenty choices, but I go wit di Blue Wallet fo Android and Sparrow Wallet for my desktop.

Export di keys from Jade and import dem to Blue Wallet dey quick and e no get stress. problem no dey wit di QR scan.

Na di same process fo sparrow Wallet cause plenty stress fo di ass. I don no if na di compatibility wahala, if di camera fo my business laptop sucks, or sometin else dey happen, but e no dey well.

E take me plenty time to get di status bar to load am to100% when scan di QR code. I nearly give up before e finally work. I try adjust di brightness levels fo di Jade, but dat wan no help. Option no dey to take change di QR density fo Jade. It was quite difficult to center the Jade in the middle of the scan surface that Sparrow Wallet provides and figure out the angle correctly.

Anyone here wey get jade? u don try pair am wit Sparrow Wallet? If yes, wetin be ur experience?

Wallet Recovery

Fo stateless mode, Jade dey wipe em self clean every time u turn am off. Di next time u turn and on am back, u go need to re-scan ur SeedQR to be able to work wit ur wallet. Scan di QR wit Jade dey work fine fine, but u go make sure say dey no get any shadow fo QR template because dat go dey slow down di process.

Because na passphrase wey hard I dey use, e dey takes time to enter am wit di Jade. Di device get di direction wheel for up wey u go use to swipe between di characters and enter dem one by one. U go need small time to get dere if u wan navigate between upper and lowercase character, special-case character, and leta.

Dey get di way to make dis process easy fo una. If u go into di Options of una Jade and select “BIP39 Passphrase”, you fit change di method frm “Manual” to “Wordlist.” Wit di manual mode, u go enter one character after di other. Wit “Wordlist,” u fit only use word frm di BIP39 wordlist. As soon as u enter di first few characters, Jade go allow u to select di possible  word combination to take speed up di process. All words go be in lowercase characters wit di automatic empty space between dem, except di last word.

Send & Receive di Transactions

Whn ur SeedQR dey load into Jade, u fit verify dat di receiving address fo ur companion app de belongs to dat seed. By scan di addresses’ QR code, di Jade go show u if na di part of ur wallet. I dey like do am fo peace of mind.

Sending to Jade dey pretty self-explanatory. Di process to send am frm di Jade na di same as dat of any airgapped hardware wallet. U go create di transaction fo di companion app, bring am over di PSBT to di hardware device via QR code fo signing, and bring back di sign transaction fo broadcast fo di hot wallet.

Send from Jade fo connection wit di Blue Wallet dey easy. I no get problems to scan di sign transaction to broadcast am fo Blue Wallet. Again, na di Sparrow Wallet fo my desktop wey create problems, and I no fit scan di QR code dis time at all.

Overall Experience

For di price of dis device, I dey satisfy. I go prefer if I go fit use em connection wit Sparrow Wallet, but as I take explain am before, e no dey work properly.
Na good wallet. I don already move some bitcoin to am, and I dey wait for good chance make I combine move to anoda stash.