Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Hope you are giving review to the recent P2P scammers
by
CryptopreneurBrainboss
on 02/05/2025, 15:21:43 UTC
It is sad that this has become so popular in our p2p trades, if you be buyer on these platform and you feel say you no dey make enough money from the commission wey you dey earn, then stop the business and go look for something else to do, which one you wan try scam person wey wan sell their coins, it is very unfair.

Na we dey always use our own hand spoil things for ourselves. Na so this thing go continue until Bybit go decide to leave us because we dey give them bad names. Scammers dey everywhere and anywhere them go fit scam and get away with it they'll try to take advantage of those platforms. Them know say we no go fit go police go dey report crypto scams since the government for the country no support this things na why we get plenty of them trying to get away with things like this under the pretence that it was a honest mistake. Sha na we go need they dey watchful of our transactions so we no go become victims because this scammers no dey stop anything soon instead we'll begin to see inflow of reported cases because as the scams dey get more popular, na so we go dey get more people being interested in trying to scam others this way abi no be Nigerians again.