Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: FG don pass law way recognize Bitcoin
by
Pokapoka124
on 05/05/2025, 11:15:31 UTC
FG don pass law way recognize Bitcoin

So as we Dey round up the mouth of April, following the plenty kata kata way CBEX bring to our Nigerian people way plenty persons loss their investments, business money, loaned money and even money way them generate from property way them sell just to invest for CBEX. The thing don make FG to turn ear towards these kind of schemes to say no and even sef, them con Dey try look digital assets and cryptocurrencies way be Bitcoin amongst others to make sure say, Nigerian citizens Dey get am right.
This na speculation, Federal Government nor go dey pass law like that. Nor be CBEX be the first Ponzi scheme to use usdt and crypto tay scam Nigerians. Which day CBEX happen wey e go be because of am nai go make federal government change their stance on bitcoin to a positive one. Even sef CBEX case na negative matter for where crypto dey.

I nor trust this government anyday, them be like snake. Na Wetin go benefit them and their private business them dey do.