I know say we don discuss this topic many times here but I still need to add something because I never come across anybody wey don talk about am with pigin english and nobody don really talk how we fit take avoid becoming a victim to the p2p scammers.
Wetin Be P2p Scam?
P2P Scam na that kind of scam wey we dey encounter when we dey buy and sell our coins. When you pay for coins the person no release am for you after your payment that person don scam you and when you sell your coin the buyer send you fake alert if you rush go release your coin when you never confirm say the money enter your bank account the person don also scam you.
Wetin You Fit Do To Avoid Becoming A Victim Of P2P Scam?
If you be person way don dey enter bank well well before now you supposed know say when cashiers for bank dey arrange money if you like call dia names dem no go answer you until dem count money finish na so we supposed to dey behave anytime we dey on any p2p transaction e go help us to avoid some of the errors wey I wam list now.
1) Avoid being in a hurry to sell during p2p transaction.
2) Always confirm the name of the sender when you receive alert if it matches with the name of the person that is supposed to pay you.
3) Avoid releasing your coin before confirming your payment.
4) Watch out for fake alerts, always make few transactions when you are paid to confirm if the money still remains in your account.
5) Watch out for half payment, this is the latest p2p scam in town.
1) Avoid being in a hurry to sell during p2p transaction: Most of us dey only remember to sell our coins when we dey for tight corners and when we dey in urgent need of something because of that, we dey forget say we supposed calm down place our trade then wait for the buyer to pay us we confirm the money before we release our coins for them and because of our hurry hurry nature scammers dey always take advantage of us because most of them don understand say no be everybody dey get time to check their bank app once them see say the buyer don post say him don pay them, if we fit avoid to dey in a hurry to sell our coins we go escape being a victim to p2p scammers.
2) Always confirm the name of the sender when you receive alert if it matches with the name of the person that is supposed to pay you: Dis na another way to avoid getting scammed when you dey do p2p transaction, if you receive alert the first thing wey you supposed so na to confirm it the name of the person way send you money correspond with the name of the machant way suppose pay you if you find out say the name dey different, you no need to release the coin because e fit be say na another person send you the money no be from the original person way suppose pay you.
3) Avoid releasing your coin before confirming payment. This particular error don make some of us lose money well well for p2p transaction because we dey trust people way we know know, for any reason make we no dey release coin before we confirm payment even do say we get notification of payment make we try confirm the money first before releasing the coin e go help us not to fall victim to p2p scam.
4) Watch out for fake alerts, always make few transactions when you are paid to confirm if the money still remains in your account: We know say fake alert don dey everywhere since the country hard now and most people dey always try to play smart just to scam people when them do p2p transaction, to avoid stories that touches the heart during p2p transaction you need to make use of the money wey Dem pay you buy something even though na to buy recharge card just buy so that you fit confirm if the money still dey intact before you release your coin. You fit delay the marchant but to avoid scam you need to do anything to avoid losses.
5) Watch out for half payment, this is the latest p2p scam in town: Half payment scam don become the latest p2p scam now, if you check most complain way people dey get for p2p transaction now most of the things na issues of half payment and the only way to avoid becoming a victim is to always cross check the amount way them pay you then check the supposed amount before you release your coin, if you do this you no go fall victim to this kind of scam.
I know say plenty other ways day to avoid p2p scam you fit still add your own make all of us learn then make progress together.