Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Should we advocate for more merit source
by
Lida93
on 09/05/2025, 20:08:36 UTC
to send merit to quality post nah base on if the source get time to notice those qualify post or if eh still get enough merit to share,
Time ke? If person no get time to dey surf forum why e go first dey fight for merit source? The truth be say we no get enough merit source for we board but, I no go lie give you say merits no dey nija board. E dey but the merits dey circulate around same sets of people and that's not encouraging.

As Normal no be by merit source dem take dey share merit. All of us for nija board we get the power to send merit give post wey we know say e sharp well well... But then you go check some people post history, na only one particular set of people dem merit dey go and we dey complain say merit no dey.  
omoor, the story about merit source and merit rewards for this our local board long shaa... If we want the talk about am base on how each individual feels about it the story go long and we no go fit finish the talk even till tomorrow.

 The dichotomy that exists in the arguments about whether or not merits the really circulate for the LB from what am seeing and reading from the different comments in this thread na base on the decibel of the individual to his distance to the merit source and rewards. Nothing more!

For me I don't know how I may act if I was a merit source but I wouldn't say I would be better or worse, and this goes to even the existing and contending merit sources for the LB. May help us shaaa....