Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Some Crypto friendly banks in Nigeria today
by
Spaceman1000$
on 13/05/2025, 21:51:17 UTC
I don't know when did this new updates took place because the last time I checked, banks were warning customers not to use accounts for anything crypto related to avoid freeze of account. Maybe, these banks just wrote it and haven't started operating on cryptocurrency. I will advise you not to use your bank account to buy crypto directly but use p2p trade to avoid trouble.
well not really planning on buying bitcoin with our Nigeria banks that me give them access to ban me account, I'm am new here was just trying to keep you updated on the local board, to me I feel I they want to use this as a trap to trap I  trusting them in buying bitcoin with the banks, I it just a formats thier trying to play here, for people fit block exchange wetin remain again.
If you know say na trap them dey set to take out bitcoiners for wahala you suppose write your topic to tell us that part too nor dey do am one side make people nor come go looseguard say one bank for naija get their back. Naija system rough o, na just recently them relax for p2p matter Igebotz sef gats close him trading thread and give announcement say he nor dey do p2p trading again because of all this government people wahala. Abeg make we dey careful.
Na true you talk BABA, EFCC self still dey put eye for people body way dey do P2P with exchange, as things dey now, I still never see that Nigerian bank wey don dey run cryptocurrency deposit, in fact if this Banks even suspect you say na crypto transactions you dey do, na them go first escalate you to either CBN or EFCC to put your account on red flag using your BVN. This commercial banks go just gaslight you with their sweet talks on how friendly them dey with cryptocurrency, no just fall enter their trap because them go use you shine.