I greet the house specially and I hope everyone dey alright. Abeg make una pardon me if such message has been dropped here before but I believe it is worth talking about.
Honestly I have taking some time to go across this our board and I have actually seen some posts wey make sense but did not receive any merit.
Let's be honest if person take out time to make good post and the post actually make sense it can serve as an encouragement to that person if they get at least a merit as a sign of recognition.
This our local board will really grow high if Nigerian see that their post made here gets recognition.
My brother I think say that era don pass becos e be like say the effort wey some people dey put for this our local board to drop post wey enter eyes no dey again, the ginger to continue no dey becos wetin to give person that thumbs up or keep it up no dey. Newbies dey try for this our board even if them dey make small small mistakes and I think say time don reach wey people wey dey as head for this our local board to do the needful if not here no fit motivate person to post becos nobody like to go where him or her no go benefit anything.