Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Make we no carry all our minds put for ATH speculations
by
Kelward
on 15/05/2025, 12:28:23 UTC
Recently wen I de visit speculation board for dis forum I de see threads wey center on predictions about wen we go see di next ATH. E de be some of us like say make e be today today and now now wey Bitcoin go surpass di current ATH and make e just de skyrocket de go. Di reality be say Bitcoin na unshakable, e be like big masquerade wey dem no de push around anyhow, our sentiments and predictions no de enough to change im price.

When Bitcoin recently touch $105k I see speculations wey predict say na within di week we go see new ATH but today e don retrace back to $101k as I de type dis post. My point be say make we no carry all our minds put for Bitcoin price speculations because e fit to fail us. Na demand and supply de determine price and e fit to go either side at anytime. Many of us de very optimistic say we still de for inside bull run and na normal thing say we go de get corrections along di way to di peak of ATH. But di reality be say nobody know exactly when bear run go start, we fit to hear one negative global news wey go just trigger am at anytime.

Some people de predict ATH to reach $150k some carry am put for $200k, and above, e fit to happen or e no go happen na just speculations all of dem be. My advice be say if you want to sell at di peak of dis bull run to make plenty profit make you no put all your trust for anybody ATH predictions because demsef no sure.