I do hear of bullrun but have never experienced it before because one was not acquainted with the knowledge of crypto then, and prior to this time I've been hearing that this year is a bull year, could it be that this upward trend in the price of Bitcoin is an indication of a bullrun, please drop your opinion so we all can learn and know how to navigate the market.
Bitcoin bull run don start since the beginning of this year if not last year ending sef. Bull run signify the uptrend movement on the price of bitcoin in the market and if you check well, you go see say that upward movement don start for sometime now and many people don already dey show for their face the happiness of seeing their portfolio grow higher. Bitcoin bull run don dey happen but them still get anticipation say e never finish and the whole of this year go still be year wey bull run go happen throughout. So bull run don begin but we still dey hope to see more of am as this year never even reach halfway wey we go begin dey expect say the bull run don finish and we don begin dey go into the bearish season.
If you check well how the market sentiment don be since the beginning of this year, overall the market dey on uptrend and until this uptrend don dey over and market change direction with some percentage of amount of inverse movement (downtrend), na when we go begin dey speculate say bear season don come. That one wey we witness for market say bitcoin don change direction and bear season don come na just consolidation and the market no really go down that much to some certain extent wey we go begin see am say bear season don begin, so bitcoin still dey on uptrend trajectory till today.