My advise naw na say, why no dedicate the next 10 years of your life the buy accumulate bitcoin with the small small money you feat the buy with. No look at the price be it up or down onto say the ship sailing na onto 10 years so currently price no get concern you till that 10 years to come. Or you feat do am 8 years which is in two bitcoin circles. Your financial life get bigger chance of changing for the better in the future to that quick hustle you the find money from.
I go talk say almost everybody wey don sabi bitcoin go wan invest in bitcoin, but d issue wey Dey be say who get d small small money wey him go use invest for 10-8 years? Dis our country no easy, and to see food chop self na problem for here, things are getting messed up on a daily basis in dis country, and sign no even say thing go change for dis country at all.
I sabi plenty people wey really get interest for bitcoin, and they really wan invest in bitcoin, but some of them no fit even eat 3 times in a day, some Dey even struggle to eat twice in a day, and Dey go take care of other things, dem no even Dey get extra money remain, because some of them na on debt dem Dey run self, how people like that wan take invest in bitcoin, person wey never see money chop, how him wan take Dey invest in bitcoin.
But anybody wey get opportunity to invest in bitcoin, then make him utilize the opportunity well, but make e no come be like say you go Dey carry loan just because you wan invest in bitcoin. If u know say you go fit Dey invest small small money, from Wetin you Dey earn, den e make sense be that.