Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Reason am
by
Cityhunter34
on 18/05/2025, 06:55:40 UTC
You done the find this money from when you realise say you done turn adult and get need for money to catch on with responsibilities when done the tie you for waist. With different alternatives and approaches to earn money in a legit manner you done apply am but no positive result to towards that financial freedom you the struggle towards for as age the climb.

My advise naw na say, why no dedicate the next 10 years of your life the buy accumulate bitcoin with the small small money you feat the buy with. No look at the price be it up or down onto say the ship sailing na onto 10 years so currently price no get concern you till that 10 years to come. Or you feat do am 8 years which is in two bitcoin circles. Your financial life get bigger chance of changing for the better in the future to that quick hustle you the find money from.

Lol op, this your post dey make me dey laugh, you say make person dedicate em life to accumulating for the next 10 years. Person wey dey struggle  for life how e wan take get the money? Abi make e go thief? Before anybody  supposed to dey think of accumulating bitcoin e supposed  don dey work wey dey pay on a stead, na that be the first thing to consider, and e get sometimes wey you go get work but e no dey reach you take survive  seff, base on the recent inflation for we country my brother think of to survive  first before you think of bitcoin. Na only the living dey fit dey get opportunities for future to invest oo, so na belle first oo.
My brother no be small thing o even me self na laugh I dey laugh like this oo because I no know how person wey never chop well go carry dedicate em life to accumulate for the next 10 years. That one be say na thief wey person go thief be that oo, because I don see say OP don forget say na person wey chop well na him go fit invest in Bitcoin and hold for that 10 years wey em dey talk. Though, na all this orientation Dem wey dey make most of our newbies panic after Dem don invest the small money wey Dem get, without remembering say na person wey get another source of income wey go fit hold Bitcoin for a long period of time.