Thanks for di very important reminder because many newbies wey just enter Bitcoin investment fit to decide to use almost all dem income to de DCA. In di end dem go come sell di BTC prematurely most times at a loss to take money solve some pressing problem. Investors need to plan to hold Bitcoin for a long term inorder to de get ROI for bull circles. To achieve long term investment plan you need to get budget for your income and you go first comot money for your primary needs like food, transportation and rent. Bitcoin investment go fall into your secondary needs, you go get discretionary funds and na from there miscellaneous expenses, emergency and investment funds go come out. Proper financial management de important for everybody so that we go de plan how to disburse money into things wey de necessary for us.