Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: A little observation.
by
Barikui1
on 19/05/2025, 12:10:32 UTC


You see all these threads on merit this and merit that eh, I no feel say we suppose Dey dwell on this matter like this. We Dey make am look like say, we no fit earn merits from other boards or something.
What was the case when we had no local board, no local board merit source and all we had for a merit source was CB that was designated for altcoins with very limited allocation…? We no been Dey get all these and that complaints about merits from left, right and center. We were doing just fine and should be even better now.

If you good, e no go be for only local board, the better way you better need to Dey show for outside this our local board too:
My boss you don talk well, I think say na only me don dy reason this thing since, for the short period of time I don stay for this forum, I don observe say you can get merit from anywhere, as long as wetin you dy talk make sense, and if you look at most of us here in details, like 70% or more of our merit we dy get na for general board, so the constant merit complain no make sense to me because if you dy give out quality, merit go come either in our local board or general board.

Secondly, we all need to know say our moderator no go fit dy everywhere all the time, him no go fit do pas himself, because the workload go dy too much on am, if him try to be omni present, na only post wey him see wey dy worthy, him fit merit, so wetin I go talk is that make we try improve on our post quality, after that, the merit go come slow and steady either for our local board or for general board.