Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: The dangers of too much intake of hard drugs.
by
Stable090
on 22/05/2025, 21:00:03 UTC
It is quit unfortunate that in our local societies today,the intake of hard drugs in now common that those who take it no longer hide in taking it.
Drug na like normal thing for d society wey wey Dey now, if you even Dey some places, and you no Dey follow dem do drugs, dem go Dey use one kin eye Dey look you, but Wetin Dey suprise me pass na him be say Wetin those people Dey get from those drugs wey dem Dey take? If you Dey reason say you get problem, and na only that drug go make u forget ur problem, make u just know say d problem na just temporarily u go forget am, if ur eye clear finish you go still face am, so instead of taking drugs, why not just look for way to solve the problem.

The law enforcement agencies that is supposed to check mate this people are even taking it more...
The law enforcement and people wey Dey take d drugs, difference no Dey, if all those drugs enforcement arrest people wey Dey do all dis drugs, any drug wey dem meet with dem, na d law enforcement Dey take am again, some go seize drugs from people, still go back to sell am give other sets again.

Seriously government suppose find solution to dis, because d rate at which people Dey do drugs now no funny ooo, and na why even crime rate Dey increase be that. Some people fit do anything if dem don high already, and some ready go to anything just to get money to high.