Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Why Nigerian should invest in Assets in this present economy, Bitcoin assets
by
Princess Leah
on 23/05/2025, 11:54:41 UTC
Asset are properties that appreciate over time, surprising many don't know this but goes ahead in acquiring cars, expensive jewelries and home appliances all these depreciate over time but assets include Land, house, good business opportunities that appreciate over time like investment in Bitcoin one assert that most people are still struggling to come to terms with.

I know say e get points wey you dey try make but how far, shay you dun see say the house appliances and the cars done increase in price so. Car wey be 1M before is now being sold for close to 10 million so low key this things na assets for Nigeria oh but on a global scales, they aren't assets but don't let buying assets deceive you from buying appliances that'll help you live a comfortable life as a man. Get a car if you have the money and need for a car, don't buy when there's no need. As our hustle so na mostly online, need no too dey for car but if the money dey, buy am because that car price no dey come down anytime soon. Things just dey increase they go for the country. Invest in assets and also invest in owning properties as it'll save you from paying double in the future when you want to buy them.

Oga boss, I love this your statement and I dey see am as better advise instead of normal comment or opinion, the place wey capture my heart na where you say our work na mostly online and much need no go too dey for car cause the work no go require us to most about, but if money dey and any person get personal need for car make them buy  am, na serious advice be that.

 Now some people still dey try patch their life, them no even get any investment on ground but them go rush go buy car just to impress their woman or wife cause their friend done buy, make them buy too, that car go turn liability on the long run cause them no dey use am generate income and cost of maintenance go dey chop the small money wey the person dey try us survive, to get car dey important if need dey, but when no need dey for car eh go come turn liability.